LIFE'S CREED NPC , EPISODE 3 ENTRY BY @OGOOWINMER

in #npc7 years ago

IMG_20180127_081155_0.jpgThe Creed Of Life. NPC; Episode 3. ENTRY MAMA @OGOOWInner
I get believe sey na every person get right to be seen , heard and loved
I get believe sey all person dey equal
I get believe sey dis world big pass make we dey disturb awa self
I get believe sey every person get one thing wey im sabi do for this life.
I get believe sey every one dey special and unique
I get believe sey na every person get SKUSHI for head and and goodness , but as for me , me go try dey scope my SKISHI.
I get believe sey tribe, religion and social status are scope wey some people dey use control others
I know sey I go dey do people as i want make dem dey do me.
Me I no go dey use bad eye look people based on how dem be but how i wan make them be.
Me I no go do any parol or packaging wey go spoil anoder person own
Me I go dey try understand people not dey judge dem
Me I no go allow bad belle , envy or jealousy and selfishness control my motives
Me self go do something wey nice for dis world before i go die
I go try dey strong whenever i face gbese , or wahala
Me I no go allow make fear dey shark me
Me I no go allow make my shakushaku thought dey occupy my mind i go dey change am with science students thought
I go always dey do like me , no fake life
Me I sure sey if ah pit my heart for something? ,I go bubble for the parol
Me I get believe sey life na journey , no be marathon so , i no go follow person dey compete
Me I get believe for peace
Me I get believe to dey help person
Me I get believe to dey pardon person
Me I get believe for love
Me I get believe for mercy
Me I get believe sey justice na for all
I believe in ADAM peekinz
Na me get decicion to live and not merely dey
I.........(@the-fundraiser)go abide by this codes till i die