Naija pidgin challenge: Make una tell us why una like Steemit

in #npc7 years ago (edited)

 Beautiful university of Nigeria Nsukka (UNN) Library 

Hello steemians, happy new week from @ogoowinner


I guess some of you might be wondering what language I used for my topic. Well, it is called broken English, also known as Nigerian pidgin. It is largely spoken in all the Anglophone West African nations. 

Here in Nigeria, more than English, most of us love pidgin and we use as our lingua franca. 

This challenge for our pidgin lovers. I hope you get to understand it and share the fun. 

My Naija people o, I dey hail una. 

I been talk for my last post say we go start our pigin challenge. We go dey do am in different categories. Sometimes me or another person go write for English then the rest of us go translate am to pidgin.

For this challenge eh, everybody na winner o! 

How we go dey take do am 


Every Monday and Saturday go be our pidgin challenge days. E fit come in as say make we translate something or make we just yarn something for pidgin. 

We go always use this tag for our posts #npc (E mean; Naija Pidgin Challenge)

No forget to add the Nigerian tag for your posts o! 

Your post no go dey less than hundred words.

Add picture and description of one fine naija site or person for your post. 

I go dey try my best to always visit una entries. 

So our challenge for today na; make una tell us why una like steemit. 

See my own entry

I like steemit well well because the thing don change my life big time. 

Before I join dem for here eh, Twinkas show me wee. In fact dem pour pepper inside my eyes. Dem carry broom sweep my house just as APC dey do us now. No be only dem o, even gethelp and giversforum join show me shagey. 

But as I join this place eh, everything con change. E no dey easy o, because e get the time wey we dey write sef, we no dey get anything. 

Another thing wey make me like this place be say, e dey help person develop ein sef. I don get plenty plenty experience from here. Even how to make money, maintain good relationship and plenty other things sha. 

The last one be say, as e be say I be dat kind shy person sef,  I no too get friends before o, but this place don make me get plenty  friends, including plenty children wey I don be their mama sef. Lol! 

When I dey cry 3 days ago, na @ehiboss call me dey comfort me sef. All my people for ogoowinner winners forum and my people here show me plenty love. If to say I no dey here na, na who for do all these things for me? My people, I hail una again. 

Na these things and many more make dis place dey totori my body. 

I'll use the opportunity to appreciate all of you who spared your time to  comfort me here as regards to my uncle's death. I say a big "Thank You"  to all of you. 

I'll also like to announce the  winner of the liquid payout for that post. @nmalove helped to pick the winner. The liquid payout will go to @steem-lagos as a contribution to save a little girl's life. 

image source: imgur.com

I remain your lovely and loyal @ogoowinner

@elyaque made this beautiful badge for me.

Sort:  
There are 2 pages
Pages

You too much....i hope the little girl gets well soonest...i dey feel u for dis challenge oo...e make sense die...biko mk i go do my entry shap shap!

madam calm down why you dey rush, this talk whey you carry come make sense like person whey invest for btc, all of us whey be naija go run am as e dey more original than writi writi whey dem oyibo say make we dey do, i go jam you for road now, as e dey go,
marshalllife from the other side.

Chai! dis thing dey sweet my body. Make dem no hear you o! Lol!

lol me i have lock my mouth to prevent stories that touch.

Lit👌👌👌👌👌.... Tanda wait for me.. I go Sama you my own entry soon. Your brain dey dere ooo... Make we jollificate with this correct ogbonge challenge. Doh @ogoowinner

My bro I dey feel you for here well well. Weldon!

You Don finally give me chance to showcase my luv for steemit. I Don Kukuma make dey post see the link here why me too love steemit
Thank you

I happy say you like am. Weldon.

Shuo!!! As the tin be now wey madam @ogoowinner don give somebody like me to show case my talent with pidgin so, I go Mara till I Mara ra on osha pra pra level. I go drop am na na na!

I haf faint! you be master for dis pigin stuff o.

e no easy ooo. Steem show me wen too ooo. He been take like 2 months before I realize say na chat go fit help me https://steemit.chat. I sign up for the chat becuase sign up for there na instanta. I greet people there wella, then I start to complain say I never receive confirmation to join. One person tag me tell me say make I write my complain inside the #help room. One the same day one admin guy contact me. We talk small then, him send me link say make I fill form. After I do am, I think e take less than 2 week na him confirmation land my inbox. I guess you fit say the rest na history. I dey like this site so far even though I no dey make too much right now. But hope dey, my sister, hope dey!

I dey tell you, plenty hope dey. Join the challenge make we start from there.

I give you tiri gbosa for this one ooo my sister. How person wan define impact again na? See as you wan give us small enjoyment from wetin steemit don do for you. Your head dey dere oooo. Me, I love you @ogoowinner. Well done for this one ooo

Thank you ma sista. Abeg join the challenge make we carry go!

I dey feel una dai.. Me sef don drop my own for yonder o! Based on logistics.. I don hash tag am #npc

Omor this your yan go well, accept my condolence based on your uncle death, i dey sure say you been love the man well well.

I stand gidigba for this challenge them.

Thank you. Oya make we run de paro.

Lol, sure things

Wawu!(my own way of saying waoh!). Na dis one den dey call serious matter. Dis your concept na serious business. So make we just dey yarn for our own pidgin. Ok ooooo na @ogoowinner start am o (lol). Good one my personal pesin. Below na my own entry link. I hail o.

Na my entry link be dis o : https://steemit.com/npc/@optimistdehinde/h1-chai-see-as-steemit-don-change-my-tori-ogoowinner-nigeria-pidgin-contest-entry-h1

Just dey fine jo

Na my own entry be this oh
https://steemit.com/npc/@ajremy/naija-pidgin-contest

I hope sey in dey saucy and juicy enough for u

This yan sweet me sote.. I go jeje join the contest. Make we continue this better yan.

Hehe aunty @ogoowinner this your contest na one in town o

Oyaaaa mum, i no go carry last for this one oo.
Make i go sharperly write my own oo

you sef dey?? omo me sef ah don dey ground for dix parole yakata

Chai.....dis thing make brain no be small, d thing na sha pra pra something.... and I for like join d contest oo, d thing wey dey there b say I b new person 4 here.

@ogoowinner Make u adopt me as ur pikin first

Sho!!! Make we follow gada look as the thing go be na... People dey selfish for steemit ooo, na so i go just loose this kind opportunity? Thank baba God say i no sleep i for no see this ogbonge contest.... Oya make i follow chook mouth na.

@ogoowinner this topic so make sense, since wer I come this place na one of the topics be dis wer sweet me to write. Here na my link https://steemit.com/npc/@enajo/why-i-like-steemit-naija-pidgin-challenge . you fit just look see as e be.

Oyaa naa... mae all of us dey drop naija official language shey?? notin dey.... ah ready die

I don die oo, i dey thank my madam wey decide to give us this kind challenge... Abeg madam i hail o @ogoowinner... You don com make me remember wetin gethelp and mmm do me eh,,i for commit sucide o

sorry about your uncles death.. nice write up dear

@ogoowinner
As e take tohtohri me na xo i drop am o
Na my own be this...

https://steemit.com/npc/@aerick/na-steemit-sure-pass

Oboy! As d mara don set like so eh, no dulling o omo.. Sharperly me don follow up d mata with my own level gan. No time o, I nor come Lagos come dull mysef o, Maka why! I canur coman look ushe face na! As e dey hot na, me don drop my own koro koro for the link when dey ground so.. You dey feel me? Oya kpomkpi make you sef check am out!

https://steemit.com/npc/@yowanetwork/naija-pidgin-challenge-walai-e-legit-koro-koro-no-be-small

what is pidgin @ogoowinner?

Pidgin is a broken English language we speak in Nigeria

For example ; how are you when translated to pigin will be '' Bros, how far Na? Which levels?

Chai! This @ogoowinner, na this pidgin sontin go sweet pass.
See as i de happy as i come the relate for here with pidgin.
Na pidgin all man de hear pass for this our end.
God go bless you well well.
Make we begin de yarn this yarn de go

@ogoowinner
dis ya photo for dis post sef dey make me wan go back to lion den. i be super lion ohh! anyway shaa, i like steemit no be small. steemit don helep me show me way for crypto. i even folo join for that twinkas wayo. chai. even cycler show me peper but steemit don dey show me say light borokoto for this side! I dey enjoy nija and africa tag no be small na im Oga Donald for yanki wan pour sand sand for our gari say we dey shithole continent, na im i come carry steemit post hammer am tel am say we for mama africa get people like ogoowinner !
i wan ask u sometn sef, you dey sleep at all or steemit don turn u to winch like me wey no dey sleep for night;)
i dash u sometn for this post, use am buy gari smoke for skul.
Sorry for your loss
Thanks for sharing this!

me i like this challenge, e make sense well well. Ogo make you try dey pusham we go join hand makam sweet

O boy eh! I hail o, steemit na baba o as ein don helep me, build me, gimme liver soteh, me we be say i no too dey talk before cum begin dey make friends, dey folo big fishes yarn. Steemit don better my life as i don sabi things wey be say i no fit go school go learn. I salute you o oga @ogoowinner as you don gimme opportunity for the challenge

Naija and innovation na 5 and 6

Me just say make I peep see wetin dey shelle. E be like say dem plenty for here. I go return, make I go Mama Nkechi joint go wak first.

Haha. Hope say she get meat wey get oil on top.

Dat one dey na, imagine say you go chop without oil, which kain chop go come be dat one na? :)

Oga boss.... I think na only me twinkas beat with hin kobo iono say u sef gada join sha.

Chai @ogoowinner, baba God love me wellaoo, any ponzi wey i wan do dey always crash before i put head. I be wan join MMM, the thing crash i put my money for pocket, i say make i go do twinkas, the thing stop to dey pay. As i enter steemit, e come dey show me shege as i no sabi talk plenty, but now as i don dey talk small small i don dey enjoy am. Na so i don dey carry phone and laptop like yahoo boy, for office, for toilet, for road na so my eye go dey for phone. This thing dey sweet like sugaroo. Abeg i dey hear ogoowinner's forum, i no come dey forumo, how your girl fit join?

I no too sabi pidgin, but I go try dey participate for the challenge. Una well done @ogoowinner.

Lol😂😂 the part
Twinkas and GetHelp eh choi
I no fit forget wetin Get-Help did to me in 2017
Ein dey terrible....
Mah arrange my own Entry sharp sharp

Make Nepa bring light first make I charge PC
I go Sama you more than

I just dey always feel you, you don do well, I dey hail o

steemit is a life changing platform :)

Aunty, weti na? why you like english like this Na. Weti self? na we chop your bread?
Shuu. Abeg O... find where drink water oh.

E taya me sef o.. Hehe wod pipo.. Isolryt

I don land gidigba... Chai!!
I too go love this contest o...Thanks @ogoowinner for this kind beta challenge. Make I go alat my guys.

I don land gidigba... Chai!!
I too go love this contest o...Thanks @ogoowinner for this kind beta challenge. Make I go alat my guys.

@Ogoowinner this post enter class, see ern twinks, 247helper send me go castina state, them one kill me and my guys, Shuoo thank God say @hornblende come save me because I don turn cast caster casted before.

E good to see wetin dey for here. Me wan be rebel o. Na yoruba I go take write my own. :p. Hahaha. Anyway, I throway salute for una, I dey see the ogbonge work u dey do for here. Fire on.

chai!!!!!!

i no fit miss this one
@ogoowinner i don enter dis one

Lol, that twinkas part sweet me die. MMM nko? You no follow do that one?
Anyway sha, you try well well for this ur post.

Wehdone oh

@ogoowinner

E dey very good say you don bring up something like this wey go showcase our ogbonge people of obodo naija. Ah no too sabi pidgin but ah go trry dis one just for fun.

I have heard only about Engrish before. Nigerian pidgin sounds more pleasantly, judging by your post :)

I'm telling you... Pigin Swt like banga soup

Omo like 10years after when I leave school, na steemit come make me pick Biro again begin crack brain of wetin to write and post. Omo this steemit make my brain come sharp back and the thing come even dey change life join am. Now I just dream of steemit and any small chance when I get for my place my hustle omo I don carry Biro sharply begin make post.... Steemit you be baba o.... I comot cap for you.

this is a beautiful post we have to appreciate what we have got

e no easy o as ponzi show plenty people shege, i bin fall victim for so many even my sister dey suffer am till now but twale to steemit as e dey put smiles for our faces. I dey hail u wela mama d mama.

Ohh.. Naso my village people wan put sand sand for my garri..see as I don make post since con forget to drop link for here....
God pass una o.... see my post here

As I dey see am so, e be like say my naija people don dey get ground well for here. My belle dey sweet me as I dey write this one sef...
Street ti take over.. Naija ti take over.

There are 2 pages
Pages