My naija people I throw way salute to all of una.
Una welcome to this our account wey we go dey use discus serious tori and even comedy as e take concern Nigeria and Nigerians.
Today, we go like discuss wetin don dey happen for our naija tey tey.
Una know say election na next year and na we wey be youth our politicians dey carry do all the yeye jobs. Na we be the future of Nigeria but how we go fit do anything when we dey allow our old papa dem push us anyhow?
Anyways, make we discuss this matter as e take be.
As our president Gen, Muhammadu Buhari take dey lead us so, una like am?
Wetin be the thing we him dey do wey una like?
Wetin him dey do wey una no like?
Wetin be the advice wey una fit give am to help our naija better?
Wetin be the way forward for our youth of naija?
If a fellow youth say him wan contest una go gree vote for the person? Because I don dey warm up o! Lol!
Abeg na dis things I go like make we chuk mouth inside today.
Yarn am as e take dey for your mind.
Five people wey yarn correct things here go receive 50% percent of the sbd wey we go collect from this post.
Abeg remember to follow this account, upvotes and Resteem.
Who fit make avatar for this account for us? Abeg show face.
Make una help us choose Wetin our next topic go be. Person wey other people happy with him suggestion well well, we go use him topic and him go collect 5% of the sbd wey we go get from the post.
That man for that picture na Saka my mentor o! Lol!
Image source
Una doh o!
Mummy na u oooo
You don come again with sweet sweet thing. Anyway me sef go yarn my own.
hmmm, this one na serious questions o, but make I yan my own sha. the fact remains that even if its me or you dey rule at the moment we go dey complain say things no right and na only baba God fit do the right thing. Say Baba dey do his best o and make we just pray make things better for us when he's still dey rule.
The only thing wey me like we baba dey do na the N'power wey he dey give youth money make den use top belle....Abi at all at all na ehm bad. And all those boko haram people don reduce so he dey try.
The thing wey me no like na how he dey appoint his people for top top post for government and herdsmen wey dey do wayo for people right now e no do anything about it.
My advice for naija be say Make we pray make naija better, make we find something doing like handiwork and make we unite so that naija go better
Wetin be the way forward for our youth of naija?
Make we think big and start small. make each of us engage in little thing that will make money come. our government national cake no fit reach everybody. make we engage in handiwork.
The thing be say, the youth wey we dey talk about, shey that youth sef no wan steal money too cos youth dis days na zobo face dey dea eyes ooo den no send anybody. And hope dey no go turn Aso rock to club house and start to dey dance shaku shaku. To me I go just vote for who I think e go pay us cos only God sabi the best.
Thanks mummy for the love wey you dey show me always. I remain your humblesmith oh sorry humble daughter.
Hmm! Wetin me wan talk be say, no be sey buhari no dey try oo but im matter just be like a tree wey no fit make a forest. Abeg, all the people wey surround the man no allow im effort show. If e give clue say person embezzle money, e no fit just throw the accused for prison nah. Na to give barristers and Chief judges to do dem job. But all this so called Chief judges go dey shift cases till everything die down when dey don collect bribe. Who dey at fault? Na so all this things dey happen for different sectors.
Okay, all this Boko Haram, herds men. Who dey support them? No be dem cliques, so called oppositions. No be all this police dey bother wey ammunitions still dey come in? They no fit do anything cos their Oga at the top don give dem order to allow passage free after e don collect bribery.
So called activist just dey shout future leaders. Them dey show for social media but dem no fit take actions. Them be dogs wey sabi but wey no fit bite, sorry to say but e dey pain me wella.
Wait oo, make I burst your brain small. For this our country, we get better LEADERS amidst our youths than our so called papa wey just dey RULE without qualities of good leadership.
My own advice oo, if all this activist fit put head together or we youths and have a youth political party even if na only two sef, na wahala e go be for this for nothing parties wey dey spoil our country.
As for me oo, I go vote youth ooo. We fit come together do this thing, I tell you. Make we choose correct youths. Wetin this men they do, e sure me sey our youth go do better.
I no say some go dey think sey youth go chop money. Make I tell una, na small small we go eradicate the money wey this youth go swallow compared to this so called our papa wey don swallow devil come dey bury money for sock-away.
Na my mind be dis oo. I dey happy to express myself as this ooo.
Dis government don show us pepper but we sure say our youth go beta?
You don try as you put mouth for this mata.
The thing wey dem show us pass pepper my brother. You go beta, I tell you.
Time don reach wey we take dey yarn matta as e be. As I be so politics no dey concern me because i feel say e no affect me but na lie. E affect me. E affect my papa and mama and e affect my broda and sista. For this we country naija we don suffer no be small.
I never see anything we our president buhari do wey I like o. Make we talk am as e be the man no dey try. He talk say e dey fight corruption but all d money we dey talk say dey recover na where e enter abeg? Okay see our road na so die people dey die there because road no good. If heaven cry water go full everywhere because we no get where the water go from pass. Our clinic them no get beta structure to treat person make e well and this our president know na im make am wen he sick na obodo oyibo he go carry him body go make oyibo dokita treat am. Na so e suppose be?
Our skool nko? Their pikin Dem no dey go skl for we country na obodo oyibo skl na em sweet Dem pass na I'm make wen our teachers Dem for here talk say make Dem do them beta or dey go drop chalk govermenti no go send. Fuel no dey light no dey. Our money no get value again e no fit buy any beta thing and we wey be govt workers no dey increase our salary. Na d same money we still dey collect wey no dey reach anywhere.
I go like make buhari put eye down arrange this nation make e beta. Make e put people wey go work. Make e put money for our schools and hospital and make e stop this nama people wey dey Waka about dey kil people.
Youth our mumu don do. Make we no dey help this people Dem dey do all d bad bad things weyy Dem dey do. Election dey come na we dey go use steal ballot box and kill people abeg our mumu don do. Make we stand for our right and join hand knack this old people comot.
Na we be d future of tomorrow time don reach make be like France get person weyy e blood still fresh as our president. We youth go support the person because we know say e understand wetin we dey go thru. @naijapidgin I throway salute.
@zizymena we throway salute. You don try as you put mouth for this matta.
doh o!
Thanks 4 this oppurtunity @naijapigin
Naija? as dis country tak as in b , me no dey understand oo. C aw awa president dey do us, him 1st stat wit fake promise change d change him get b4 election 4 us .wetin jonatan do 4 subsid neva do? buari cum cos resesion even wen we neva balanc 4 jona wahala. nw shey we don com c wetin petrol dey sey everytin don cost pepsin go get car no fuel. in come cost lik sey we dey find gold and the funali herdsmen wahala stil dey oo,
4 me as Buhari take dey lead us soo me no lyk am, him no even do 1 tin wey pesin lyk. No 1 tin i want mak him do na to solve those herdsmen case bcos alot of people don die and nw i still hear dey neva stop at list mak him do dis. dollar matter him no solve him com dy sey him grt hearing probs.
D only tin i fit sey na mak God save us in this country ,na dis b d no1 tin naija youth fit do. If a fellow youth say him wan contest i go vote mak we give trial , i don tired of dis old men wey dey rule us.
You don try as you put mouth for this matter.
For this matter way day ground so, plenty things day man mouth to talk.
How we go day country where things no day align well and instead make youths day reason way forward, they day campaign for old men way get hand for the kata kata way day ground.
Me, I Don day zero my mind commot all this leaders them because na followers day always decide the kain leader way they get. My own na say make we youths look our self for mirror come yarn ourselves the truth. Wetin be the truth? We no day try.
Everywhere, boys day hustle quick way to make money. No body won develop patience, resilience and ingenuity. No, na how person fit make money na him everybody eye day. This kain shortsightedness no fit help us choose better leaders and develop our nation
The babes themselves day find man way go be their father, brother, sponsor, bouncer in fact everything way an entire village be. After, they go day claim gender equality. They no won learn from how our mama then day do better business bring money come house.
Plus, we still day reason ethnic and religious matter. Once person come from my town, I gat day him back. This kain attitude no fit help us. Old or young, Christian or Muslim, Yoruba, Ibo or Hausa, make we just focus on people way get better vision and support am.
If all of us gather hand say we won change on our own, better leader go come out. After all, no be people like you and me day civil service, police, teachers, etc. I believe say once we don arrange our matter as youth, even if we elect thief as president, the thief go day fear to show him face because everybody day alert and updoing. No body get time for nonsense like tribalism or religious discrimination. But where everyone day wait for messiah, na trouble o. Whether na youth or old man, everyone fit day corrupt. Besides, one man no fit do everything.
The moral of my story be say, a better Nigeria with better leaders day our hand. Maybe how you take appreciate your own property, no him person go take handle am
You don yarn better yarn. Wehdon for this talk wey you put for the matter.
The way this tori dey go,make i just they follow am. I no no say this kind thing go come up for here, i don dey write about naija tori for the past few weeks,you fit check my blog to see for ya self cos naija wahala don tire peson.
Weting me i like about behari be say he dey help us getting the money wey the looter don carry commot from government porch,but i no like the way he dey do am well,because na only those who no dey en party e dey arrest.
Anoda thing i no like about en govenrment be say,he don spoil our economy,before e enter power,person wey dey collect 18k salary fit buy 10 bags of cement with en salary,but now he no fit buy 5.
Before e com to power,he promis us say en go lead d troop go sambisa forest go cinfront bokoharam,he never tell us say he go substitute them with en people. En people done kill with gun,cultlass and knife more than bokoharam do with bomb,n he never see waitin en go do to stop them,en com they tell us make we maintain the peace, i cry for naija
Another thing be say, d way he dey give us xmas bonus on peltrol every year since e com into power dey tire person,we no fit celebrat xmas well well again,we no fit travel.
Another one be say,the way en governor dey whole salary dey too terrible,how person go work for a year without salary? Na only for naija they fit do that.
I don dey talk am,if no youth or new person contest for 2019 election,i no go vote. I no fit waist my time inside sun and still sufer dis kind suffer for four years. For m and for my family no youth or new person,mean no vote.
Let m reserve d rest for una reply,i dey burn well well.... Smile
We don too suffer for naija, wetin you fit advise buhari make edo as e still dey office?
U don try as you put mouth for this matter.
Wetin me fit advice be say
Make en fight corruption generally no b say e go dey fight am at random
Make en enforce his governor to pay salary,he should deal with anyone wey no one comply
He should control en people make they stop killing
And final one be say he should ask for en ministers report,anyone wey no do very well make en ask him to go and make en replace such with young perein wey be say na en field be that. No be say you go bring another lawyer make en day control transport. Smile
Your talk make sense, you don try..
My brother ...Na Papa God go bless you for bringing this topic... When e been be campaign time them been talk say de go make naira dey equal to U.S dollar($)..But wetin come happen now be say even if you safe ₦1 from january till december you go only get $1 when the year finish. Nepotism na one thing wey i no like at all for this government. Any young person wey wan take the mantle of leadership...me i go support am fulltime.
#nottooyoungtorun
Make we open eye vote the right person, make these things no dey happen again.
doh o!
na me be dis once again. Make I run yan my own apata make i do am berekete make fifu paduna.
dis our naija,na democracy we talk say we dey do, but stori don change. Our naija youth no dey run and since when i dey small i dey hear am say youth be d leaders of tomorrow but me never use my korokoro eyes see am o.
Wetin i for like be say, make dem allow youth too rule. All dis our old papa dem make them go rest and just dey allow youth do am and rest to just dey give advice.
Na weitin we want for Naija, make our old papa gree our youth to rule, make it be better youth no be person wey go destroy our nation.
You don try..
true talk. Because our youth self their blood kukuma don dey corrupted. My conclusion be say make God come make dis world end
My brother/sister d mata con tire me o infact this country sef tire me join... Day talk wey u say young person mk e be presido for we kwantri me sef tell u say we young pipo no go gree vote young person why na greed!! N yes tout go still dey unto say money dry n person no go see money say no to am.
My own always be say mk we young people find sontin do for we self.... Start with 1k/day soon u go d see 5k so money no go carry u go grave.
Anyway laslas I no tink say buhari go win again Wetn I for like add be mk we youths try choose person wey go benefit us carry we all along else e go still remain laidis
Okay the talk for next time suppose be "how we fit better ourselves for this kwantri... Wetn oyinbo d call entrepreneurship"
True talk, Make our young people dey try help themselves.
You don try..
Una doh o... @naijapigin I greet una.. Na human being for Obodo'yinbo (Bill Gates) talk say hin see where the world wey we dey dey go, hin con position wella.
As Nigeria be so, me I don see where the world dey go and na Agriculture levels. The goverment too don see am, nain make them they give farmers loan make dem take am go farm
Na the only tin wey I see say Buhari don do for our Naija and na the only better thing wey e do be dat, the other tins wey hin dey do, na for za other room. Lol
The advice wey me I get for my fello youth be say, make we go invest for Agriculture oooooo... If na for fish farming, abi na Crop, abi na Poultry, anyone wey una fit do, make una just start am, especially crop farming.
As per voting, me I go advice make we go for we we... Person wey dey capable, wey they young, person wey still stand kakaraka
Na so e dey my own mind ooo @oredebby
I hail una once again. Make una enjoy una day
@oredebby we hail u oo. Wetin you talk na better talk, as work no dey Naija make our youth start something take help themselves o.
You don try. Doh o!
I no evn like the problem,de use bokoharam take spoil Jonathan regime,give votes to northern children, make Jonathan look like bad person,then our gullible youths vote the devil in disguise, buhari don make life difficult for everybody,fulani herdsmen de disturb everywhere, instead the aboki president de talk say make we no retaliate to alow one useless peace reign,just yesterday, Fulani men attack ore road,kill people like water,our aboki president go lock up say him no hear am ooo....I DON TAYA
This coming 2019,mak we come out vote youth with vision and not old men wey senior our country
That ore road stori, you sure say na true? Abeg give us suggestion how e take better. Thank you for adding mouth for this tori.
The tori na true ooo
I even get the voice not the university girls make
My suggestions be say,make dem send soldiers go round the country,Biafra agitated for smll thing,them send soldiers kill everybody ,now Fulani DEY misbehave, aboki president dey keep quite.
This country no fit dey in peace, make we just divide,bcos the abokis dey fell like na their birth right to rule
Make God helep our countri, make our government fit stop wetin fulani herdsmen dey do.
You don try as you don put mouth for this mata. doh o
I hail o, na me be @Josediccus, you see for we country I see say buhari na man wey neva live up to expectation, the promise wey e make people say e go bring change still dey pepper people for body, him don fail to fufil him promise, see the benue killing him no fit do anything as people dey pkuff anyhow for herdsmen people hand.
For me I no like him indecision and lack of courage.
Our eye dey Chuck and I no use anything like am.
See say obasanjo don tell am make him make him no run a lot of people even Reverend mbaka def.
Hunger dey evrybodi still dey feel the fetemuye of recession, what of him cabinet wey full hausa people?
The man gas commot.
However him day talk true, and that one na him e take good.
I hail una I be @josediccus again
Make our next topic be, how we go take stop the herdsmen killing for benue.?
My brotheroo,, na the Benue killing worse pass now, we dey pray make God help our country..
You don try for wetin you talk..
U do well, Wella, I happy for we naija pidgin fowe to dey jollificate
I go fit make avatar for the account
but i make i yarn my own fes.... See e go hard make young person win any elections based on say him neva serve dem godfathers them... The way naija be u gats work ur way up... Before young pesn go don work am reach dat level e go don old na.... But if i see young pesn wey dey contest i go vote am.... D level wey naija dey so i no sure e fit bad pass dis one
Na true talk.. But e go better make young person commot first, make e be say e no win.
No b lie sha.... Atleast make the attempt even dey record say pesn try atleast... Make e no b say na only for mouth we dey talk am
No b lie sha.... Atleast make the attempt even dey record say pesn try atleast... Make e no b say na only for mouth we dey talk am
No b lie sha.... Atleast make the attempt even dey record say pesn try atleast... Make e no b say na only for mouth we dey talk am
Mi i no fit shout sef bcos d mata don tire me.... Make our leaders still dey do as them promise make we for happy vote for them again anytime wen election reach abeg!
Hmmm... buhari try sha, becos so many people get empowered recently.... But e for good if them allow youth try power first make we see how e go bi (hehe)
Another advice bi say make we just dey pray make baba God beta our country for us.
I just dey hear of this post, i go follow sharp sharp and resteem make oders wen never hear if this post still come yarn their mind.
Hope i no spoil anytin oo ?Na my mind a yarn i no fit shout.
Wadoh!
You know spoil anythingo, e good as you yarn wetin dey your mind. True talk, na babaGod fit better our countrioo. make we pray, as we dey pray make we work join.
You don try as you put mouth for this mata..
Bro @olusolaemmanuel for resteeming this post o. den don bring wetin i sabi chop like indomi come. I happy so tey i go sit-down for ground because pidgin don enter steemit too. How I wish i fit dey blog for my account with my account.
For dis our naija,no light, no work, no water, bad road, in fact bad network to browse. If know be steemit wey dey pay us now and many naija guys don turn here to their work place..
Naija witches don affect sbd and steem now, bad market low price. Wetin person go come do now.
Make our oga at the top find sometin do to help guy's o. From all this yama yama o, to marry self no be small money. And work know dey ground, me tired o
You don try as you put mouth for this mata..
Wetin you think say Buhari fit do, make things better?
Sir baba dey try oooo,baba dey try in best wer he fit dooo,dat time wer he dey contest,na almost all of us talk say we want change but we no get patient to ask if na positive change abi na negative change as for me i no believe say d man go even do all dis thing wer he don do because d baba don old,I believe say young person go fit make our country better because e go no watin we youth want.
But my own question be say
(1) Which day we youth go b leaders?because na since wen I dey primary school dey don talk say we be leaders of tomorrow..
(2) When D tomorrow go come?
E go good if better youth gather morale come contest. U don try as you put mouth for this mata.
My brother, as u see naija so, na envy and jealousy dey kill us. And government too no help matter, my own idea be say make everybody go dey independent, make we learn one trade or the other, make una no rely on government too much.... Steemt sef na way for the fortunate ones, and i pray say GOD bless NIGERIA
Abeg I go like make we talk about this nama people wey say they way colony for our next episode. Na better thing be dat?
Hello @naija pidgin ,
Well done.
Baba Buhari dey try ooo... Na naija don get plenty wahala tehteh.
We go dey hope ,pray and support Sai Baba
E good as i be una follower.
Thanks
@unique18
person wai no fit use pigin his or her name na sorry. naija go better, infact already better.
@ naijapidgin, my people this stori wey une trowey for we here na beta one o, i rememba for we office yesterday we come de arguement about this country how them buhari don spoil things for us finish, my people 4 office come dey vex for me o say buhari na good person say him beta pass Jona, imagine i come ask them say how e fit be so? Buhari wey make us for we country loose job over 7 million for im 2yrs for power. See torey wey dey for ground about herdsmen killing owa people everywhere. Make we tell our people to get their voters card. We must throwey dem comot with our card o.
@eugenecr7, wehdon o.
Wetin you fit advise Buhari make e do better our Naija
see ehn d tin wey me go talk na sey u see for this country the problem na sey everybody sabi sey d tins wey our leaders dey do no pure but instead make we come together and fight for what is right we go just dey chase after money na bcos sey most of our youth just dey after money them no even wan try better d country na why tins be like dis i dey talk am sey if youth stand up for this country things go better things go move forward bcos na unto sey those old men see sey if dem throw small money for ground alll d youth go just dey at their feet na why dem go continue to dey march us but me believe sey if we stand up forget money and fight for wetin dey right this country go move forward them obodo oyinbo ppl dey talk sey rome no be one day dem use build am if our generation start the one we go follow us go carry on and when we don old we go dey proud to sey na we make dis country better
thank you @naijapidgin for dis opportunity u give me to speak my mind plenty still dey for me to say but make i save am for later thank you alll
You don try as you put mouth for this mata.
My people i hail una. Naija shall live on. With all the turmoil we still dey push forward. Nevertheless e still get one or two things wey we go need address. Naija as a nation we never sidon ask oursef wetin we truly want. Na person wey dey socially driven abi na person wey dey policy driven. Na until we know wetin we want na b4 we go know how to decide. . if person wey dey contest na 35yrs and him fit offer wetin we require, why not. And if him opponent is 68 and still dey confused abeg make we send am packing. People dey suffer everyday no be lab rats dem be naw. If you no know wetin you get to offer the people abeg step aside. Time no dey for childs play. But as e dey be we must know wetin we want. My people Your vote na your power.
U don try as you put mouth for this mata.
D tin wey i go talk be say na we dey do ourselves with our hands and na only we go fit correct our mistakes by ourselves
omo dis our country mata don tire me
See as fulani herdmen just dey kill farmers everywhere yet our oga at the top no dey do anything concerning d mata, We fit dey overlook dat mata now but when we go start to dey feel am na when famine start to dey show face.
If you kill all d farmers finish who go produce d food for us?
Next harvest go dey really low because of dis killings, na still we e go affect. I still wan kontinue but make i stop here
Infakiti, I go drop one post wey concern dis mata
Weh don! You try..
For me o...wetin i go talk for d mata be say, i dey reazin say this our president don tire for d problems wey dey comot during dis him tenure. Him been no expect say tins for bad reach as e dey now. Him been dey tink say him get everything figured out.. E come bad say dose pepo wen him trust to help am rule don fail. Him administration no even know d depths of d problems anymore. I rememba say before him come power, e dey tok saywithin few months say him go don deal with insurgency... Now e no be only boko haram wey dey terrorize dis our country.. Even him village pepo wey be dis herdsmen don turn to terror for d country..come to think na who even buy gun give dem.. The truth be say nigeria go dey better off if him no just contest. If truetrue him love naija as him dey claim mame him rest make anoda person come try wether dem go fit clean up d mess wey buhari don make. In d name of cleaning up d mess wey odas past administration make him don put us inside even bigger pot of soup
Wetin me de advice everybody for here be say make we jejely try go get our PVC. Na that one go be our power com 2019. Na by that we go take show say our mumu don do for this our obodo naija
NAIJA guyz and girlsis I hail o, I Kom like as una dey do am for here o. E beta make we edificate wetin we get, as in make we appreciate am well o, no place wey be like home
Hmm, as he dey hot so for this our country election so. No body know wetin be the best coco to do. The people wey don show intrest so, my brother i no go talk oo but nija need help oo.
But if make i choose. I no go lie you i go choose Buhari, if nah only him and Atiku wan fight am. Because you know say oyibo man talk am say the devil him know better pass the angel him no know.
Nah like this me dey see am oo.
I don go carry my PVC keep am dey wait. Make dem waka come
I don join kpatakpata. Make we dey go on sharp sharp
Na everybody wey no like how baba buhari dy rule the country, because as baba Don enter president post, na so 5naira and 10naira useless, light no dy for rural areas na only GRAs and Estate dy get light pass.
So as for me wetin I won give be say make dem lock all our leader for one building and explode the building, make all of them die with fire and still go enter hell fire for heaven.
See our leader are too old, them no sabi wetin fit naija, all dy care about na ther family and the money wey dem go embezzle. Naija needs A average man wey be say he no too young and old. So d person fit sabi how to rule the country.
Further more, na we get petroleum and na we still dy suffer from it, dem go increase price today, price tomorrow asive we naija people get money to buy petrol like dat, money no dy and dem dy increase petrol price.
Naija need a good and experienced leader... Not thieves
my people this matter wey dey for ground na very serious matter oooooo. abeg for the people wey go like torchlight the matter with us, i go like make we commot our political magomago so that we fit torchlight the matter the way e be.
my own advice for mr. president na say make him commot that single treasury account system. that thing follow for wey thing follow keep our economy like this. before now every ministry get account with their different banks and na this money wey bank dey borrow private investors and me and you know say the private sector na the major driver of any economy. but now banks no fit hold this money because of the single treasury account system.