NIGERIA PIDGIN CHALLENGE; EPISODE3.....THE CREED OF LIFE

in #npc7 years ago

FB_IMG_1485618611927.jpg
My fellow steamians i salute una oo! Our people dey talk say Live, make i live na e dey make life sweet. So for today's edition of this our ogbonge naija pidgin challenge, i go dey talk about dey The creed of life, read and enjoy yourself yafu-yafu.

THE CREED OF LIFE

I believe say everybody get right make people see'am, hear'am and love'am.

I believe say every human being dey equal.

I believe say dey world dey very big to accommodate everybody.

I believe say everybody get one place we be say e be Oga for dis life.

I believe say everybody dey special and different.

I believe say everybody get character wey bad an dey one wey good, wey dey inside him bodi. So I go dey make sure say na dey one wey good I go dey show people.

I believe say people, religion and level wey dem dey, no be anything na just to create people wey go control odas, cause wahala and carry mind say na dem be Oga come put for head. So I accept say make I be human being first before any people, religion or level.

I go dey treat people dey way I go like make dem dey treat me.

I no go follow people dey yarn becus of wetin dem be but becus of wetin I wan make dem be.

I no go follow do any business wey go cause wahala to people.

I go try make sure say I no judge people but na to understand dem.

I no go allow envy, jealousi an greed make e control wetin I dey do.

I go make sure say I do one beta thing wey go helep everybody before I go comot for dis world.

I go make sure say I dey strong even wen things dey good an wen e no dey good.

I no go allow fear make e come dey move me.

I no go allow anything wey dey bad come dey my mind, I go make sure say anytime wey bad thing wan enter my mind, I go replace'am with good one , becus I no say something wey dey mind get power.

I no go copy people.

I no say I go do beta if I hustle wel, wel for dey work wey I dey do.

I no say dis life na jeje, no be fight, so I no go follow anybody fight becus of wetin dey life.

I believe in peace.
I believe in helep
I believe forgiveness
I believe in love
I believe in mercy
I believe in justice for everybody
I believe in people
I don decide say I go live no be to just dey exist.

Me wey be Joseph-jnr go follow dis creed till dye day wey I go comot for dis life.

Thanks for reading;
Still on Nigeria Pidgin challenge, picture wey I put na for UNIZIK na him I snap'am