My personalized version of The Creed of Life. NPC; Episode 3 by @ogoowinner

in #npc7 years ago

pBdaWLVYg_aF.jpg
My guy olamide
Image source: instagram

Na so oga madam @ogoowinner talk say make we personalize im creed wey she post. You go see dat one for up if you wan read am.
Before I go start, You see ehn this life na chop make I chop. No put every tin for your pocket forget people wey no get reach you. Bcos all na vanity, one day you go peme commot dis world and you no go carry anytin commot. So notin go do u make u do good for diz life .
Na my own creed b diz.

Me believe say every person dey d same so you suppose dey hear,see and love Err'body with same mind.

I believe say dis world wey baba God create ehn, dey enough make we gada dey togeda.

I bliv say every body sabi in im own way, no judge me d way you judge bill gate.

I bliv say every body get bad and good for im mind so e go beta make we do more good so tey we go forget do bad.

I bliv say e no mean say our color different abi our religion abi our money, bkuz upon every tin every one be human being.

I go dey try to treat people d way wey I go like make dem treat me.

Me I no go do wetin go make oda people cry or dey sad ontop say I wan dey happy or get money and I go dey try to understand people make I no dey judge dem.

I no go allow jealousy enter my head bkuz say my mates get better thing pass me and I go make sure say wen I die people go talk better thing about me untop wetin I go don do for dem.

I go dey be myself and no go copy another person bkuz say im don make am pass me.

See ehn, u no need b pastor or imam until you do all dis things abi until you go church, mosque or get bocoo money before you epp people. Dat little wey you gey ehn, use am do good and you go see say you dey get more.

I thank our madam again oh...aunty after you na you oh @ogoowinner