Naija Pigdin Challenge - The Creed of Life

in #npc7 years ago

image

Me believe say we all get beta right make person see us, hear us and make them love us.

Me believe say we all for this earth dey equal to other people dem. No body big pass anybody.

Me believe say this world big well well and e fit contain all of us.

Me believe say every person sabi something wella even if na for one area of life.

Me believe say every person make sense for him own way.

Me believe say we all get bad and beta spirit inside us. Me go do everything make the beta spirit carry hand for my side.

Me believe say race, religion and social status be nothing. But waiting matter be say make we put "human first".

I go dey do people how I for like make them do me.

Me no go ginger for who you be but on how i want make you be.

I no go dey do anything way go cause kasala for another man pikin, na things way go bring beta for man pikin them Na it I go the do.

I go dey cool down dey relate with person before i go cause wahala for where wahala no dey.

Me no go get bad belle or put sand sand for another person matter.

I go make sure say before i comot this earth, i go make sure say i do at least one better thing for life were go stand gidiba.

I go dey try stand gidigba, when wahala,
or bad thing happen.

Me no go allow make fear the catch me any how.

Me no go allow make bad bad this carry my mind, and if e show I go pursue am sharp sharp.

Me go dey always dey as I dey, i no go thé copy copy people anyhow.

Me believe say this life na jeje, no be competition.

Me no dey like wahala.

Me believe to the do good.

Me believe to the forgive.

Me believe for love.

Me believe for mercy.

Me believe for justice.

Me believe for everybody as e dey so.

Me don decide say na " live", i no go comot this world like that.

Me Ella Xavier, i go live by this things till me comot for this world.

Thanks aunty @ogoowinner, God bless you.