na xo e be, too much forming no dey hep.
As e be say na pidgin i dey speak, many people fit no like am, but i like am on my own, as i no sabi speak oyibo but i won dey steem, forming no go help me. So e betta make i dey do my thing with joy for get about the money.
You are viewing a single comment's thread from:
Na so e be my brother, we go dey form posh say we no go wear Aba-made shoe wen e make sense wella
u correct jioor, for outside nigeria aba-made na foreign
You no lie, na so e be, I be even hear say dem dey export am go Italy and our people go follow enter there go buy am as per say na "foreign" e be.
u dey on point.
Hahaha....Area!!!!!....na true yarn be that my brother. Na who forming Don help?....my belief in the Nigerian community dey solid kampe. Very soon, you go dey collect dough to teach people pidgin on the blockchain. Carry go, brother.