Ma Naija people how una dey, I trowey salute give una oooo.
And I welcome all of una to our ogbonge naijapidgin blog.
As una know say Monday dey carry different swag diferrent effizy. So as it go be today, na street we wan enter, we wan see abi hear dat koko thing wey dey sup for una street. Make una just dey follow me as I dey talk am.
As the topic don dey, I know say we fit no understand am wella.
So wetin d topic dey yarn us about be say: wetin be dat word, dat one word wey dey trend for una street, it fit be your house or una community.
Wetin be dat koko word wey everyone dey talk.....
@naijapidgin entry..
As I dey think am like this, I know say plenty people go don know this word...
Sha Pra Pra....
Na this single word dey trend for ma area as u dey read dis post like dis. As I fit translate dis word, hmmn, na just to say ' the thing dey hot for una body'
So wetin we wan make una do
U go just waka to d comment zone.
Make una post ur entry for dat word wey dey trend, wey dey shake all una street and how u take understand d word..
The word fit be our lingual franca and it fit be ur street or una community language..
All eligible entries fit win something........
Make una come join us for our Whatsapp group by 9pm
If u neba join click here
Na @horlaide create dis post for naijapidgin
Avatar designed by @mittymartz
Lyk dis so eeehh, for my area BBN just dey trend every where u just need to see how d street dry yesterday to watch d eviction. So actually nah the theme for dis year bbn which be "double wahala" nah im dey burst boys brain around here. Small tin u don hear somebody say double wahala...lol
BBN don burst una area... , u pipu be d biggest bro for naija
Nice!
Una weledone oooooo,
For my area nah 2 Words de shake our Street oo.
D first one na shaku shaku
The second one na Bbn eviction.
Common to cross road go buy pure water this morning , na so one Yoruba guy de shout ..
won ti shaku Ify enada kuro ni ile biv blother yehh..
I just laugh throwaway 😁😁😁😁😁😁😁
Wow! Shaku vs bbn, una try oooo
Nice! Nice !!
Oshaprapra!
Gbefun!
These two are my favourite.
Then everyone asks Wakanda lately.... "Wakanda thing is this?" "Wakanda life is this?"
Wow, wakanda for u oo, abi I no try...
Nice!
Una good Morin my fellow people, the word wey dey trend for my hood na "kofa kofa". You know that kind feelings when you commot from your land go one foreign land wey u no even Sabi deir language. Instead make dem say "corper" den go dey call you kofa
If I no miss road, dat pipu suppose be Hausa, kofa tofe....
Nice!
Naso
Una good morning o. I no even know the word wey dey trend for my areas because work no dey give me time to follow Dem yarn. I go just read other people own learn
Make una no vex @zizymena
I know say una no belong to d street..
Una good morning my ogbonge naija pidgin, d tori wey dey rain for my street be say "shakusaku" if u do slightly mistake u will be called "shakusaku" for the wrong tin u do
Hmmmn shakushaku dance, shakushaku babe, shakushaku everything, I swear ur street get mouth..
Nice! Nice!!
As in eh the word wey dey trend for my side na ooo wash
I no know the song wey this slang take enter but e dey trend like mad for my area
Na 'o_ wash...' dey turn up una area...
Nice! Nice!! Nice!!!
Unto the mara! I salute una jejely o! Omo for the area men, the level when dem they yarn na 'kole werk!' Pipo no won hear word o, if them hear sai baba, dem go hala 'kole werk!' 😁
-@yowanetwork
Sai baba=kole work.. Ur street go dey political concious oo...
Nice!
D phrase weh dey trend 4 my side na opoleti owuwolowo n ise bangladesh...
D 2 phrases mean smtn weh mk sense but d second phrase na 4 heavy endowments 4 women dem body...
Hmmn, I know say na u dey rule ya street.
Nice!
My pipu my pipu
u greet una o
wetin the reign for my area Na comot make i faint
Bros, abeg no faint here, space no dey...
Nice!
My pipu my pipu
u greet una o
wetin the reign for my area Na comot make i faint
My people unah weldone the word wey d trend for my area nah lick.
Lick nah when u want arrange your fellow babe
Oliver, I wan dey suspect u
Lick
my contri people, I dey through way greetings give una o, this ogbonge word wey dey para for awa area na:
Even that your entry sef dey too.
Everything come dey like dat..
Nice!
Everything come dey like dat..
Nice!
Oya na my country people based on logistics ehn...na shaku shaku dey reign for zaga...and you knw we naija na..we no get weyti we dey use am for..if you fuck up, you don shaku ...if you do well you be correct shaku ...hahahahahahaha..
I dey on my way dey go house now, I just see this matter for telegram.
For my church , the word wey dey rain na BUT WHY
For my street, the word wey dey rain na WON TI GET E (Dem don catch u)
Lol, wetin you want talk na "nwon to get e". Omo Igbo to so Yoruba 😁😁😁 .
Happy Birthday dear
The thing wey people dey yarn for my area na "is a goal", "shaku shaku", "omo science" and "working class". Na runs girls dem dey call working class.
Hmmmm i gret una oo how una mara dey be for dix area na', hop e legit for all of una sha.
Anyway all d shaku shaku peopl wai dey here, abeg as e dai hot for area soo every tin wai u won do just free style run am shaku shaku make e for makin brain come legit join. Na so d mata dey hapen for my area sooo,
Base on shaku shaku logistic tinx.
The word wey they trend for my area na:-
The second word na
All hands on deck
My peepu i throw way cap for una tie leather for head...una too much jor.
As e b lyk dis so eh na Science Student dey reign 4 my area oh...every hustler now don turn science student