NIGERIAN MEN NAH THE BEST FOR AFRICA?

in #naijapidgin6 years ago

DQmUKSUbJf6GJypWe3AotmHNRN95riKkHAk52cqMRqfHJ2x.jpeg

Una good morning o my country people how the weather dey for una side as we don enter rainy season everywhere go dey cool.

Today na Wednesday the middle of the week and I sure say people don reach office since even students too don enter class.

Na one tori I carry come for una this morning wey my eyes jam and I wan share am with una na one fine Ghanian shenkes na im talk the matter her name na Zipporah.

After all the plenty plenty story say men no good and men na evill people na im she talk say as for her o after several heartbreak the Nigerian man when she dey date presently na him dey give her joy intact say before she meet the bobo she always talk say all men are the same but when she jam the bobo her story change.

She even talk say Nigerian men no dey beat woman say instead of them to beat woman them dey waka comot,na so she just dey hail them so she con advice Nigerian women say make them dey appreciate their men because na them be the best for Africa

Abeg my people wetin una get to talk for this matter,na true say Nigerian men na the best?
Make help us chook mouth for dis tori....

no forget to d support us with your upvote comment and resteem.

you fit join our discord channel too here where d thing d happen

nah @rosyblessing bring dis one for us.

nah @mittymartz give us dis fine avarta

IMG-20180604-WA0015.jpg

Sort:  

Me biliv say evrytn 4 life dey depend on the part weh face u o... Na d bright side face some pple and na d dark side face some pple...
So depending on the side weh face peson, na wetin person go use mk judgement. As pa dis ghanian sisi so, na d bright side face ha, so na positive comments u go everly hear....
But as far as I sabi, 9ja men weh dey educated, learned, mature and wise no dey beat dia women....
Most Nigerian women-beaters na poor unexposed illiterates...
Na my own view though...
Mk una enjoy una day, pple of naijapidgin community...

My brother you don yarn better and I see plenty sense for this your matter wey you yarn so any how Sha we go always d pray make d better side of life dey face u.
Thank you say u chook mouth for this our tori

I hail una @naijapidgin. Nigerian men are truly adorable, caring and loving. We know how to show women love in every area.

That one no mean say we know get flaws too, but we dey try. Congratulations to the lady sey she meet better man.

Nah so!! Thank you my brother for this mouth wey you chook for our Tori today me I know say naijapidgin men no dey carry last for love matter

@naijapidgin e don tey o..lol
Omo no be joke, our men sweet pass, dem no watsup, how e dey take happen...i twale for our naija men...una too much!

Thank you jawe

Coming to your dm right away..... I found a wife

Lol, no mind am

Wow nice one, exceptional and excellent...... Pidgin sounds nice.

U r too gbasky bae, u too sabi abeg...

Lol, i de loyal boss

Smiles. Who tell you say Nigerian men no dey beat? Shuu. You neva come accross man wey get skuri for head like all these agbero boys. Na only God fit help choose the right man for us wey go dey calm and responsible. I no talk say na every nigerian men dey beat o,make I no hear slap for my face. Them even plenty pass the ones wey good. So I think say the ghanian lady don see man wey dey compatible with am. If ladies go marry anyhow man,na so the man go dey do anyhow for house o. But we must oppose men wey dey beat their lady. Make we make dem know say na animal dey do that kain thing.

I no get much to say but the fact be say nigerian men wey dey beat their woman dey. Dem dey for my area sef.

Correct men no dey beat their wives. Dem dey cherish and appreciate them, come buy them bleaching cream make dem take dey shine. Any man wey dey beat im wife no be man at all. Thats why e better make we dey look well before we carry join body go alta with somebori. Una doh

Exactly. Na true wey that Ghanaian shenkes yarn you oo. Better correct talk in fact for my Naija men nor dey joke with anything wey dem dey call female gender. We respect women die and the thing don be like that since the days of our four fathers them.

Men are everly adorable. The rythme that make lady heart to be at rest. @naijapidgin una dey see well.

Na talk she talk oo.. She never jam some rough 9ja men sha, she use one man dey conclude.