NAIJAPIDGIN WANT SAMA 6 LUCKY PEOPLE 15SBD

in #naijapidgin7 years ago (edited)

Aha my people, una very good morning o. Today na Sunday and yes na contest Sunday. Oya begin dey joli. Yes o, nothing do you. Today na Sunday and na beginning of a new week. Una know say during the week, we win 500 SP delegation from @ejemai and body still dey sweet us.
image
In the spirit of jollification, we don decide to host ogbonge contest. I know say una like contest but who knows like better thing? Na so now but no forget say awoof dey purge Belle o.

WETIN D CONTEST BE ALL ABOUT

E easy well well, we want know those of una wey dey very creative and wey fit make person laugh piss for body.

So una go write on this topic, "Blind date experience". Una Sabi wetin be blind date abi? If you no Sabi ask your neighbors.

Wetin we want make you do?

  1. You write on the topic, "BLIND DATE EXPERIENCE" for your blog then you go copy the link come drop for here for us.

  2. You go gather people to come upvote that your link for you. You go must get 10upvotes from people to qualify. No worry 10 upvotes easy to get.

  3. You go use #naijapidgin tag so we go fit find you.

  4. You go upvote this post and reesteem am.

Na so, e don finish.

How we go choose winners

  1. We go check weda you follow the rules 1-4

  2. We go check how creative your work be.

  3. We go check how funny your work be and how you take speak the pidgin well even use appropriate pidgin proverb join.

  4. We go check weda na copy you copy abi na original work.

AWARDS

1st winner go carry 5SBD

2nd winner go carry4SBD

3rd winner go carry 3SBD

E remain 3SBD abi? We go share am between 4,5,6 positions. You see? You must win something if you try your best.

JUDGES

Na all the admins go judge this contest

Oya wetin you dey wait for, carry go p jaire.

Na @zizymena write this for @naijapidgin. If you never join our WhatsApp group, oya click here

image
Na @mittymartz design this avatar for us.

Sort:  

Na so! Na so! I don come with my own talk. I hope say una fit follow read am make I join sama the Sbd wey una dey win here always. Lol

Na my work be this
https://steemit.com/naijapidgin/@oredebby/blind-date-experience

@zizymena I hail o... @naijapidgin I greet you. Happy Sunday

This is my entry https://steemit.com/naijapidgin/@princefizzy/blind-date-experience-naijapidgin-contest-c91539e019cb4
Read am make u for learn lesson
Itz ur boy @princefizzy
Show some love
Blessing @naijapidgin

I'm sure the girl learnt her lessons

Narrow escape u had, the girl should face the consequences of longer throat

Good luck man

Na my entry for the contest be this i hope say ona go like am shaa, i salute the people wey dey behind this contest wey be @naijapidgin una do well to dey help us wey be say we be small fish for this platform. Ona fit check my entry here shaa drop comment if una like am
https://steemit.com/story/@deeclown/blind-date-experience-my-sunday-service-in-barracks

i cannot write an article. i just upvote u, thanks if you upvote me back

I dey come make I go prepare my Tori. I swear una go laugh tear shirt. But e get wetin I won know, na the original post suppose get the 10upvotes abi na the comment when I go post for here

Omo this contest na ogbonge one oh

I hope say this one no be first come first serve ooo, bcos people don go church finish fa

D contest d last for one week

Weyti me and @julietisrael go do now as we no sabi speak pidgin 😢😢

But you can speak na

I will write a story when I'm back from church and you'll help me change it to pidgin English...

How about that?

@julietisrael I like that your deal come make we discuss

Okay, cool.
Hit me up on Discord
Julietisrael#8805

I'll get back to you when I return from church.

Una go pray for othe

😁😁😁🤣😂🤣 you no sabi speak pidgin wetin you speak now na wetin? PIDGEON

Una well done o. Happy Sunday to you all.

As i no sabi write for pidgin, i envy una wen fit write for pidgin, una carry go oo.

Upvoted,commented and resteemed make e for no loss.... (winks)

Wetin u come dey yarn for here, abi I shuk bottle for eye. U na area girlie na, yarn me beta make I for hear word na.

Hahaha
Na so, wait for me oo... I dey come

Loading...