Naijapidgin contest result

in #naijapidgin7 years ago (edited)

My country people I trowey salute give unah
How unah dey, hw una dey rock sunday for ur side
How unah take the hold body for this we change?
We no say ground dry dat nah why we go continue to d pray make things dey easyfor all of us
So make I officially say good morning gee to all those wey d read dis post this morning, today nah another beautiful Sunday and nah also start of another new week and as we d prepare to resume our weekly parol make we no forget to go church and to we Muslim brother make we remember pray too

IMG_20180501_100409_545.jpg
As we d do am before before…….

But before I announce d winners I wanna first of all thank unah wey don dey support us since d day wey we start, those wey join for road and those wey go still join UNAH TOO MUCH if no be because of unah we no go fit dey here so.
As unah know every Sunday for @naijapidgin nah for contest and today we wanna announce result for the contest wey we host last week so that we go fit nack dem their prices @naijapidgin nah we get am and make unah no forget to always dey support us

Oya Back To D Matta
Nah 19 pipu enter d contest for judgement and make I no lie give unah all d story make sense die, we enjoy sotey we laugh forget ourselves, nah so d thing make sense we no come know who to choose but unah know as competiton d be…….. no be everybody go win, so if you participate and you no win make you continue to d try one day baba God go pick your call too
just say make unah know
All d winners wey d judges select nah base on d rules we don dey ground for d contest
D rules nah

1. D title must b blind date
2. You must get upvote for d link wey you put for d comment section
3. You must use naijapidgin as tag
4. You must upvote d post and resteem am

Base on all things nah em winners show

Announcement

so people wey win nah


1st nah @mattyabo…………………………….. 5sbd 2nd nah @vintagerver…………………………..4sbd 3rd nah @afolwalex…………………………….3sbd

Then people wey win our 1sbd nah



We say congratulations to people we win!!!
@sola3097 @deeclown @oredebby Until we show unah domot again……….. @naijapidgin dey say thank you

no forget to d show us support with your upvote comment and resteem

Na @oliverwilliams carry dis post come una domot...
IMG_20180319_092844_398.jpg
Na @mittymartz design dis AVARTAR

Sort:  


I greet una oooo
Una well doneeeeeeeee
Thank youYaaaaaayyyyy I sha finally win something for @naijapigin

Afowalex na my guy, he talk say make una give me him gift 😹😹

Which Afolwalex???

I troway salute give una,and i wan tank una for the sunday gift wey una take put smile for my face this morning, i say thank you well well i con use dis opportunity take sama other winners say congratulation o.. @naijapidgin una do well o. Happy mothers day.

Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!

I win something ooo yeeeeeee ! halleluyah!

Thank you Naijapidgin...

Afolwalex dey troway salute

Nice contest, too bad i cant join.

Ill be needing a translator though

naijapidgin tagCongratulations!,@naijapidgin Your post has been upvoted by @naijapidgin for using the

Abeg wen next contest go show.

vintage verve joined together. E be like say I go change my name ooo, Maybe E too hard to spell..OMG! I won! Sorry @naijapidgin una no spell my name well ooo.. Na @vintageverve. I mean like

Thank you @naijapidgin


I wan mention you for something before but I no do am again because I no fit spell your name..@vintageverve e hard oo..


I wan mention you for something before but I no do am again because I no fit spell your name..@vintageverve e hard oo..

Lol! Most people no sabi spell my name. Chaiiii! @uche-nna is it fair?

It's not oo..
But the name English too much for us 😂😂😂.

I bin wan call you sef. Congrats luv.

I dey trowey salute for all una wet don win.

Nawa ooo I don dey cry self. Me I follow all the rules ooo and after all my hustle, my name no come show face. I tire ooooo

Congrats, winners

Can I submit my entry now? 😂 😂

Entry for wetin?

Congratulations to the winners oo, unah try e no easy.

@naijapidgin, a no know how a go tank you o, e con be like say a dey dream, God go bless you yafuyafu. A no even know wetin a go write again sef. Thank you @naijapidgin for the gift. Congratulations to everyone that won something.

Wen i go win my own naaa