Today Tuesday my people I greet una from the house of Naijapidgin..... Remember say our contest still de on so if you never join better go join here because 10sbd de for grab and if you de loose at d moment better find way to start to de win
Today matter pain me sotay I no fit hold am again so abeg make una help me put mouth before I vex,
I no understand why naija tin too de slow and different....
Yesterday I de for Cafe de try to reg for nysc and from morning to night the network slow and people de talk say na congestion
Now the matter na say Facebook wae people de use everyday no de ever get congestion abi na bet9ja wae people de play game everytime neva get congestion
Oya tell us the strong thing wey bad internet connection don do you.
which network for Naija get the best connection
I go start from me... I believe say na GLO
Watin you think... Drop am For the comment
@mittymartz bring today tori for us
Na @mittymartz design this avartar for our ogbonge community.
Glo??
I think say everybody dey complain about Glo.
Well, Glo make sense for where i dey. So i no too get wahala about network.
Issorite
De enjoy your Glo even me sef I de flex my Glo here
To me na mtn i vote for.... But for my service area here na Airtel and Glo good pass. So na Airtel bundle i dey sub.
i remember when i still dey play bet9ja, time of the game done almost start, i come get one ogbonge fixed match wey den send me, omo network come do me bad thing i know see the game bet and the betting shop to my house the Waka know be here own inside hot sun
See your life
So na bet9ja u take your data de do
Mtn sure sha but some places and location na GLO
read my comment. Not anymore it was once upon a time in my life
Airtel dat dey double-double thief on top pesin sub....you no talk correct atall bro!
Naija network don cast abeg! I no fit dey explain wetin e don do me
Babe I feel your pain jawe
I na know say you fit type pidgin ooo....
You get boyfriend.... Me I wan apply ooo
hehehe..!
which one be this again
no blockchain toasting o
I de look you de laugh and because you get banana head
Blockchain toasting is allowed right from day one
@Teamsteem and @karensuestudios
Na where you dey be d koko. I bin use Almost all the network for nails and every every don fumble Jor.
U talk better
The network de work with area and location
Like ekiti now
9mobile no de at all not even 1bar na offline you go see
If na for that NYSC mata, na normal tradition. The best time to register na midnite wen everibodi don sleep. E no finish, dem go say make u snap passport with white background like say d pesin wey design nysc website na cele member.
For the network, all of them get their own palava.
Glo make sense before but now even snail(congo meat) get speed pass.
Na etisalat be the best but dem dey use that mosquito straw wey dey draw blood to take remove ur data and e expensive too
For the contest, make una show una boi love with upvote
I salute Una
Even for midnight e no work
Snail fast pass am
Hello! I find your post valuable for the wafrica community! Thanks for the great post! @wafrica is now following you! ALWAYs follow @wafrica and use the wafrica tag!
Thanks for the r cumin around
thank you say you upvote this wonderful post
Na all network dey get problem but i dey gbadun Airtel because if dia network wan do somehow,dem go don beep you before that time say network go flunctuate so so day. As you know say MTN na everywhere you go,no place wia you go wey you no go see in network but e too get in own time wey e dey do rubbish,Glo na in i hate pass even my shit beta pass am. I no like them from here to there
This your own case different oooo
Glo na shit?
But na true na airtel de tell people but others, network go just off
Anything wey do with naija edu network always dey slow from waec to nysc na so the network dey be even if you wan try am for night na same thing.
The network wey dey sweet me well na Etisalat wey dey change go 9mobile. The only issue wey I get with them na, dey too cost. Jesu, dey be like G wagon. U fit just manage buy 1GB e no go last you reach 6days, but them dey fly like witch.
I know say all of us dey the competition but e no bad if una still just put hand vote for me. Thanks and Baba God bless every naija pidgin pikin
Hahahajah
First person for this life wae go say Etisalat good about na 9mobile
Na when person wan do better thing the network go dey do anyhow. As I wan do one business transaction for my internet banking, na so this network dey misbehave and I be dey busy that day, wey be say I can't go out go deposit for bank. E pain sotee I be wan cry, I try make I call their customer care service, that's one too ring they no pick. No be easy gbegeee oooo. That yellow network eh, Dem don show me.
Pele jawe
Just join the mtn gang.... Even if mtn go fuck up na smapl
Network for naija na cast to me o no best network for dis country all of dem na d same e get one day wey i wan send money give my sista thru mobile banking and e dey urgent na that day mtn no say ddem wan crase d thing pain me even yesterday wey i dey enjoy naijapidgin tori na that time bad network start i wish our networks fit dey stable for we country i go happy well well
O my chisos
You just turn me on as you say u like our tori but network no fit sha pra pra for Naija
My people, i de throw away salut, on top this nysc parol, the tin don tire me, i hear say na normal thing, but the best network for my side na mtn , the only problem be say they de use straw sock person data...haba u go subcribe, 2min e don finish...i no wan remeber wetin glo do me..na so e go de vlcrawl like snail... Abeg make i de go, i wan go register nysc
Na everybody de experience Data drainage most expecially mtn
Hmmm make una leave mata for matthias oo, as e be for naija all the network be like nepa light because na when dem like u go fit enjoy am.
But i believe say na mtn still dey onboard sha, since them still dey try pass other network for my area. dey try small to dey help people life for this side.
Everybody de talk mtn
Mtn no good for my area ooo.... Na true say all of them na nepa.... Truetalk
No be lie, you talk tru , na when e come to education matter dem dey always get network ish, for my own area, 9mobile na D baba o
U get mouth
Na God go help Naija
Because now everybody de steemit but make I try reg for one education stuff like jamb... Network go jam
me neva get too much wahala with network providers ooo unto say na airtel I dey use..
Airtel na baba abeg
I so hate airtel because them de lie
All their packages no be real
All of dem na wash ooo
I don use glo sote na me dey call customer care after I suscribe say make dem gree me use am
See as I de look your comments de shake head
You for no browse na
U funny xha..... U call customer care to let you use your data
E go b lyk 20-30 minutes b4 dem go answer person
Ahh! Where you here say GLO na correct network abeg. Me na Airtel I dey use. Wetin dey vex me pass be sey, I go wake up like this sey make I come learn small, laugh join for Naijapidgin, na im dis Naija network go come dey mumu imsef. Mtcheww e tire me abeg
Na me talk am
Glo de try for me....... But mtn sef de try
Na that airtel and 9monile de vex me
I greet the house, the strong thing wey bad network don do me be say recently i miss one better crypto signal d thing pain me die, i suspect say na village people get me dat day sha, lol bcos my trusted etisalat 4g never disappoint me like dat b4
About the network we get the best connection, i go choose etisalat bcos dem dy always dy do well for my side. Airtel sef dy try but d rest like mtn and glo na big spoil.
About the nysc palava for naija, i believe say na normal thing based on the huge traffic and the jamb site no too dy strong enough to handle dat kind traffic sometime for day time na why e good to run am for midnight when people don crash
The network wey good for me na mtn oooo.
Glo na the worstest network so far, the thing wey glo do me ehnn if I remember I go dey cry. I dey use glo browse and I won transfer money with remita the yeye network dey carry signal go on and off so tey den con over deduct my money.
i just know say na this my senseless padi naim go carry this kind matter come here and to spoil something the more em come say na glo sure pass.....
e be like you just buy your first phone this morning, Glo wey make me trek to airport on night just to browse and submit something for @surpassinggoogle post
na MTN sure pass for service but there data na rip off for some people sha
meanwhile i wan go book game for bet9ja.. :-)
So na me you de insult
I no blame you because mtn de give you 10mb why you na go yab me
Me i vote for mtn because say na almost everywhere dem de , na glo don do me atrong thing before , na ao one day i jejely sub for glo one month o say make i use am do registration for prospective corp members o so i go fit make small money o , naso glo network waka conot for my phone for like 3 days , i no fit cry that day , naso i loose customers o