CHECK AND BALANCE

in #naijapidgin6 years ago

JPEG_20180518_163148.jpg

My country people I trowey ogbonge salute for unah?
How unah dey?
How unah take d hold body for dis we change wey d touch everybody so?

Base on d spirit of celebration we for @naijapidgin still d wish unah happy democracy in arias, hope say d holiday go well for your side.

We know say e no easy to d hold on for dis our crypto parol even as e be like say everything just d go down like say e want discover oil so lol! But any how yagayaga man go survive after every every me I know say my naijapidgin people no dey carry last highest highest nah draw nah so for d crypto matter “we die here”.

But any how sha make we just d hope say better rain go fall for dis crypto make e b say man go chop wella for em hustle because nah only hope nah em make man d survive every day for jungle.

Oya back to d matter wey dey ground today nah 30th of May nah him be say month don d finish and if one d finish nah him b say another one d start b that wetin make dis one d sweet me for body b say we don cross d year into two b dat nah him b say we don reach half of d year and as e b say we don reach half of d year e better make we catch break check ourselves, check we lifes, check we activity if everything d go well “nah we call check and balance” make we check weather everything d balance for we life.

We know say for every year we d get new year resolution and plans wey we get for d year, some nah habit we dem want stop, some nah places wey dem want go, some nah things wey dem want buy, as e b say we don d reach half of d year so,

How far you don go for your plans we you get for this year?
You fit beat you chest tell yourself say I dey proud of myself say all wetin I want achieve I don achieve am?
Or you fit tell yourself say you dey road to achieve your plans?
Abeg my country make we chok mouth for dis matter
Your plan fit help another person

make you no forget to d support us with your upvote comment and resteem.

if you want join us for discord make you sharp sharp enter here

nah @oliverwilliams bring this one for us.

nah @martymittz give us dis fine avarta

IMG_20180215_155325_695.jpg

Sort:  

Well i thank baba God since we enter this year so
I throway salut give him, say i still dey in track i still dey lane.
Even tho i no really stick to some resoulution, but still i dey get better everyday.
We just dey hustle small small ooo

Una well done ooo, me i juat dey pass by oo,😇

Our steemit first lady e better say you still on track we go pray say make baba GOD carry you reach that place wey you want dey.
Baba GOD bless you today say you chook mouth for this matta

I throw way salute give una, this na my people i go dey follow una for back.....

Yes ok this nah d ogbonge naijapidgin
Nothing do you as you choose to d follow us we too go d follow u too
baba GOD bless you plenty as u decide to show face for we blog today

Well,i dey proud of myself this year,everything wey i plan i dey do am small small and before you know i go reach permanent site for the matters dem.
Una wehdone o.

Nah every body prayer make e reach permanent site o.
My brother GOD go dey with you

This your Pidgin dey sound like spanish for my ear. Oh lord Jesus

Abi!
You dey feel naijapidgin abi?

The thing tie wrapper, wear gele take hard die!

Abi!
You dey feel naijapidgin abi?

@oliverwilliams God dey help me achieve those my plans for the year smaall small e no easy sha

Nothing easy my sister but I believe say baba GOD go level d ground for em children and as e b say u Don d achieve ur plan small small baba GOD go help you run till d end.

Nothing easy my sister but I believe say baba GOD go level d ground for em children and as e b say u Don d achieve ur plan small small baba GOD go help you run till d end.

thank una very much...i salute the group oooo🙌🙏@naijapidgin

Hmm, oh boy no bi small mata, but me I believe say Baba God dey rison my mata small oo, and b4 dis month go piante blessing go fall for my life.. I go even touch light too join the beta blessing... @naijapidgin una head dey dere

Hmm, oh boy no bi small mata, but me I believe say Baba God dey rison my mata small oo, and b4 dis month go piante blessing go fall for my life.. I go even touch light too join the beta blessing... @naijapidgin una head dey dere

Hmm it's been long I Don miss this una ogbonge topic wey una they use open our eyes to matters of society make una continue I dey feel you

i no know say brothers di speak broken for here but i hail una my names na NED na medical student i be