Before I chuk
pipu the talk say dem no fit turn back the hand of time. I just wish say I fit doam.
I for use my time well.
plenty things don do me for this life wey I wish say I fit get second chance make I fit doam well.
Make I just share one.
Na love matta o.
I be get opportunity meet dis rich man pikin Wey d show me love for all round, but based on say she no too fine and her love plenty pass by own. I come the treat her anyhow. I come the feel like say the world Na my own. My pipu, my eye clear wen I lose this girl to my neighbour. Today the guy the Manage one of the girl father company.
mouth for the matta, make i First trowey salute to my naija pipu. Especially especially @oliverwilliams and @horlaide.
My brother I trowey beta salute to u o nah because of unah nah em we dey here.
U know say for this life so many thing dey happen so that we go fit learn our lesson.
Them talk say u no go value wetin u get until d thing comot for your hand.
Thank God you self reason am say you fuck up.
So now you go don get small knowledge from wetin happen so that u no go doam again .
My paddy naijapidgin dey tell you say you too much