NAIJA PIDGIN VARIETY SHOW!!! DON'T MISS OUT!!!

in #naijapidgin6 years ago (edited)

MY PEOPLE, MY PEOPLE!

I dey greet Una oooo
Happy Sunday and hope say Una dey prepare to go church or Una dey church already for my catholic Steemians!

No be only me waka come ooo, I waka with @imbigdee on behalf of all the naijapidgin crew, come make this special announcement.

Today na our first ever variety show day and yamayama full ground remain.
This show dey happen by 5:30pm after everybody Don return from church for our discord channel...

PicsArt_05-26-09.48.49.jpg

This show no be one of those promise and fail projects wey dey happen.
Our mama @ogoowinner get hand with @zizymena for this one.
Alot of giveaways follow no be for mouth.

This show get part 1 and 2 ooo! It have hapun!

Part 1 na talent show

whether na singing oooo

whether na rapping

whether na comedy

whether na to laugh people wey dey contest

whether na to vote people wey dey contest

whether na to criticize people handwork

whether na bad belle talent you get

whether na village people you be

ABEG CARRY ALL COME, WE WANT THEM.

Then part 2 na Quiz ooo
This one na for everybody wey feel say their power reach...
No fear! The questions no hard, no be WAEC!
The questions na simply based on

Some Nigerian whales and aspiring whales

Their on going projects and reputations

Gist about the recent programmes wey dey go on for naijapidgin

Questions about our beautiful Nigerian Steemians wey dey support all of us.

THIS QUIZ SBD ALREADY DEY GROUND OOO FROM @imbigdee

Abeg this show na we own, we naija people and pidgin lovers.
We need all the Nigerian Steemians support.
We also waka like that dey find more sponsors ooo so that our talented naija people go fit make am small for life. 😜😜😂😂😂

If you be naija pelzin, you be whale or aspiring whale and you never support us and as you see this post you hiss... say you no go support us... Oya carry your hand go up... raise am higher... fold am and knock your head. 😂😂😂🏃🏃🏃 Make I run before transmission transmit me go transformer.

All talented and untalented participants Oya comment, upvote and resteem this post to qualify for this contest. And make sure you join our naijapidgin discord channel from here ooo to participate ooo
FIRST THREE PERSONS TO UPVOTE, COMMENT SWEET COMMENT AND RESTEEM NA 0.1 SBD FOR GRAB EACH!

once again special thanks to our Mamas @ogoowinner and @zizymena. And my Papa 😜😜😜 @imbigdee for the giveaways wey dey wait for participants for this gbedu wey dey burst brain show. 😘😘😘😍😍😍 I love Una reach moon come back! 😱

I remain Una special gallant WarriCalabar babe Itoro Archibong.😘😘😍😍

Sort:  

Hehehe.. Lass lass you Don come be madam for this side make I kukuma set alarm keep Make I come jonz pass time..
No bring my village pipu come o.i Don dey run dem since

Boss after you na you... I just dey follow you for Yansh ooo. Oya we dey wait for you big time. 😘😘😍😍

whether na village people you be.

Abeg no invite them for the show, dem dey scatter things too much. Good luck to you and my oga at the top @imbigdee

Upvoted and Resteemed.

Hahahaha... If dem no dey... Things no go complete ooo. I troway kisses give you for your support. 😘😘😘😍

Na so na, e don tey I dey expect dis kind package on top naijapidgin... No lele na, I full ground berekete 4 d show... I go see una later n big thank you 4 una weh dey behind d success of the proposed show o...

Yes oooo. Na so we see am ooo. We dey expect you gidigba... Come showcase watin God give you. 😘😘😘 Thank You for your supportiiiiiii

Transmission transmission OK transmission 😂😂😂😂
I go Dey there

No Wahala. Transmit yourself con reach there before we start ooo

No Wahala. Transmit yourself con reach there before we start ooo

Yes oooo. Na so be that... Naijapidgin all the way. Our ogbonge people. Na we we today. Everybody shift make I pass. My talent na bad belle talent ooo 😂😂😂

Ewo... Una see am... We don get one bad belle talent already. Abeg bring am come... We want am. 😍😍😘😘👍

@Itoroarchibong, thank you for using the naijapidgin tag.

We encourage and support minnows.

Join us on discord: https://discord.gg/5SR8CH4 for more fun and to submit your posts for curation.

You like what we are doing and would like to support us? Join our trail here: https://steemauto.com/dash.php?i=15&id=1&user=naijapidgin


Sponsored by @ogoowinner

I no fit wait gan, bless u @naijapidgin and the ogas at the top.

Dis asprinig whale category na set up

Hahahahhahahahahhahahahahahahhahaahahhshshshahahahhahaha. Na Mamas like Una be these aspiring whales ooo😂😂😂 🏃 🏃 🏃

We go see today. Make i go charge my phone

O yes... I go keep your seat for you... 😘😘😍😍👍

Walahi, i like dis show like police like N100 wey dem dey collect for check point. Hahaha I go show for there by that time. But the thing be say make i neva contess, make i look , come give them moral support. Taink you, you hear? We go see later

Yes ooo. Thanks you. We still need talent of voting... 😜 so waka come wella... Your place dey wait for you. 😍😍😘😘

Congratulations @itoroarchibong! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of posts published

Click on any badge to view your Board of Honor.

To support your work, I also upvoted your post!
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

Do not miss the last announcement from @steemitboard!

Do you like SteemitBoard's project? Vote for its witness and get one more award!

Congratulations! This post has been upvoted from the communal account, @minnowsupport, by cateyes1990 from the Minnow Support Project. It's a witness project run by aggroed, ausbitbank, teamsteem, theprophet0, someguy123, neoxian, followbtcnews, and netuoso. The goal is to help Steemit grow by supporting Minnows. Please find us at the Peace, Abundance, and Liberty Network (PALnet) Discord Channel. It's a completely public and open space to all members of the Steemit community who voluntarily choose to be there.

If you would like to delegate to the Minnow Support Project you can do so by clicking on the following links: 50SP, 100SP, 250SP, 500SP, 1000SP, 5000SP.
Be sure to leave at least 50SP undelegated on your account.

This post has been upvoted by Altruistic. To get more upvote, you may use the tag altruistic-steem.

You can join us on her discord server: https://discord.gg/KHB9eJk to know more about what we do and how we can be of help. To earn more curation reward, you can follow our trail on steemauto.com or streemian.com.

altr-banner.png
Please kindly upvote this comment in order to keep us helping plankton and minnows that their quality posts are undervalued.

#altruistic-steem

Make sense