You are viewing a single comment's thread from:

RE: BLACK PANTHER MOVIE

in #naijapidgin7 years ago (edited)

Nna eh, make una kukuma go watch am for cinema. Me don go twice sef, I fit still go again.

O boy, the movie make sense no be small. Correct people full am; correct black women wey strong well-well come fine put on top, correct black men wey get power get respect carry six-pack put on top, better costume, better fight, better intelligent storyline -- and all od them black! AFRICAN SEF! Actor, Black! Boss, Black! Waka-pass too, also BLACK!

Come see African country wey strong pass oyibo! Chai! Why e no dey like dis for real life na? Na we go build am in fact!

In short, the movie na 90% over 100 walahi!

DWYRAovXcAA3Nms.jpeg

Wakanda Forever!!!!!

#wakandaforever!!!

Sort:  

omo this your rating no be small. You write am as e be in your mind.