You are viewing a single comment's thread from:

RE: Snake wey go swallow millions. How una take see am?

in #naijapidgin7 years ago

you see ehn when i first hear dis tori my body first weak as in i no even fit go lecture dat morning bcos i really really no like to dey hear stupid things i just dey reason 36 million naira SNAKE!!!! ahn ahnn shey dem think sey all of us wey dey dis country be fools abi wetin dem dey try talk when i hear am i con start to dey question my intelligence bcos if the office wey organize my admission fit talk sey snake swallow money den how i take sure sey 2x2 na 4 then d tin come even light for my head sey wetin d money they find for office shebi na online them they pay so how the money come turn cash bcos na d snake matter everybody dey talk nobody dey ask sey why d money dey there in d first place and i don notice dis thing for this country dem go talk about one big money for news and after dat one like dis nobody dey sabi wetin dey do that money after dem don see am from my heart i wan comot this country make i no come back but i alsodey reason am sey if everybody comot nobody go remain to make this country better so no i don tell myselfsey any little chance wey i get to make dis country better i no go waste am i believe sey i gat do this for my children i want make dem come meet naija wey don set make my generation no struggle like i dey do for this country once agin i dey thak you all for thischancewey una give to telk God go bless all of una thank you @ogoowinner thank you @naijapidgin thank you @steemit