The animals for this country sabi better, cows dey find colony, rat pursue presido comot, snake swallow #36 million (abeg if una see am, mae una tell say I dey find am, I wan collect my share), elections don dey near so, make another member of their kingdom no come carry ballot boxes comot polling centers.
Make we the youths participate, get better for mind and forget this chop make I chop attitude wey common for Naija.
Abio, make our ballot paper no come disappear. If to say our youth go put mind together do better thing, our countri go better.