You are viewing a single comment's thread from:

RE: Our topic today na how una take see the plenty plenty killings wey dey happen for our country?

in #naija7 years ago

Abeg this killing matter tire me. How one set of people go just wake begin dey killpeople upandan and we say we get government. The thing tire me!

Before na Boko, now na herdsmen. Tomorrow naa we fit wake up here another tory. Mebi then Na bubu himself go they shoot people say he don tire for all the insults he dey receive for social media.

But something flash my mind yesterday o. I come be dey think say mebi Na Jona dey sponsor this herdsmen to tarnish bubu image the way them do to in own with that Boko Haram stuff. Na just thinking sha.

May God help all of us for this we naija.