You are viewing a single comment's thread from:

RE: Our topic today na how una take see the plenty plenty killings wey dey happen for our country?

in #naija7 years ago

My naija people I hail una🙌🏽
@ogoowinner my sure person, you dey sabi yarn better tori, this one wey you drop so na wan jagjaga thing wey dey happen for we country..
You dey try wella @ogoowinner i hail.
@naijapidgin , I say make I talk my own for this matter because the thing na all of us e dey affect.
This die die wey dey happen ehn, dey say na Fulani herds men but make una reason this thing well oo, who Dey in charge of them , because I believe say them no go act like this if God father no stand gidigba for their back.
For me eh I dey reason say all these na political somtin oo...as all of us know, election go soon reach again, dem fit dey do all this things make fear for dey our body for the next election.
E really no dey fair say na innocent people dey suffer the thing...
Even we corpers wey dey katsina dey serve our nation we dey fear...
Na just last week my friend send me message of one geh wey escape from this attack as she dey go back Lagos from katsina..
My people make we no fear ooo because God dey our side....
Make all of us stand gidigba for this next election ,decide on who we go put for the presidential seat.
Na for naija I no say endurance na sure thing , we sabi endure things ...
we need stand on our ground this time oo make we help our fellow brothers and sisters.
God bless us all..
Thanks @ogoowinner once again .