You are viewing a single comment's thread from:

RE: Our topic today na how una take see the plenty plenty killings wey dey happen for our country?

in #naija7 years ago

This matter wey you bring come so don the chuk me for liver kumemeee. The one wey the wori me pass na the kind way we presido take take put super glue for mouth concerning this matter. You sef think am now how presido way be say na him be the first person wey this matter suppose the chuk for liver never use him two leg waka rich Benue instead him waka go lafia go see people wey the pursue cow. Him come even open mouth wey him the take chop rice and beans take say make benue people accomodate them brother wey be herdsmen. All this one follow show say them sabi something concerning this matter so my own be say make them comot monkey hand for soup before i become human being hand oh. I don talk my own oh and i no carry water for mouth as i talk am.