You are viewing a single comment's thread from:

RE: Our topic today na how una take see the plenty plenty killings wey dey happen for our country?

in #naija7 years ago

Dis matter wey una carry come ehn, na my God go bless una, say because d thing dey pain me wella, as i no understand d reason wey dis fulani people go dey carry kill people like fowl and the we government sef no too take am seriously, as dem dey talk say na foreigners. Which kind foreigners? Abeg make dem no lie give us, we don tear eye.

All dis one wey dem dey do, wetin me think be say na to just create fear for inside people mind, as e be say people no get trust for dem again, so dem con decide say dem go create fear with all dem dis fulani people, so we go come vote dem again. But e no go work. Breeze don blow we don see fowl yansh, make dem try deceive us again, we don wise. All d thing wey dey happen so na plan work, make my fellow Nigerians no let dem deceive us again, d one wey dem don do e don reach, make dem dey go, cos i no understand why dem no fit fight dem dis fulani people.

One thing wey vex me well well inside dis matter wey dey make me talj say na plan work na d time wey dem ask oga presido about d matter and he come talj say during oga jona time, say d people wey die pass the one wey don dey for him time. Another one nah him attitude towards d matter. Dem kill people for Benue our presido no gree go, but him son get accident wey be say na because of him carelessness oo, he dey talk say make all Nigerians dey pray for am life no be so.

So my fellow country people make we no let dem fear us, d thing wey dey happen just show say d government no dey for us and my only solution na to change dem wen 2019 don reach.