Injured People : A Freewrite

in Freewriters7 hours ago

FUkUE5bzkAZT3HzV5tJDiU2ik81PCd4JCyhWnRcDN8XJsVFY3UNB8DCSkDrnRBuY7tnU4ERztptECfMJfK3DBtLNrJF5S6hGxLdXqvKMAkdG2pDhbUAhHQ4jZdWzfaFojfifdV85Yq1YSGMCFkZaThRAXMLYip2JCgri.webp
The second one na when I dey journey I think years ago.

Ondo state I think,, for corner, the trailer dey come, we sef dey come, naso trailer troway o and we dey approach with speed and na just two lanes. If u dey travel well, u go Sabi how those roads be

Beside us na rocks, no bush to deviate enter, na the trailer lane na him off-shoulder dey. As the trailer falls for our front dey drag come and covering both lanes at the se time, na only God knows how our driver take enter fast and furious mode, the werey enter ultra instinct mode straight, change course enter the trailer lane, enter off-shoulder, comot from the trailer back 😂
Third one na recently, I dey go Lasu, wan go meet my bro

Inside rain o for that mile road. Naso the oloriburuku faragon just enter road from corner, and we all know say most commercial vehicles, aside BRT for Lagos, na expire tires, tires wey no get grip again.

Omo, our driver match brake, e no catch o. He no wan hit the bus wey enter road from side cos e go fatal for the passengers inside that one, another bus again wey park jeje dey plan to enter na him take the hit.

A couple of people injured for our own bus
Guy it's crazy
Una go don call all the God ne make una sabi at that moment
People shout o