You are viewing a single comment's thread from:

RE: Sam’s Hangout #81 -”NEPA”

in Hive Naija2 months ago

It's PHCN, not NEPA (I dey my house, come and fight me). 🫣

By the way, I think say the change from NEPA to PHCN go make us dey get steady light but e be like say na now e dey worse.

If I even see steady light, heart dey cut me because them fit go on one blackout wey nor go wan end. Although them dey try for some areas sha and I dey enjoy am sometimes.

How do you cope when “NEPA takes light?

Power bank ways or I make friend with who get solar, life nor hard normally. Even generator now, fuel price nor let near where e dey.

If you had the power to fix Nigeria’s electricity issues, what would be your first move?"

People wey get power now never fit fix am, na me go come fit fix am? Omo! But sha, I go check wetin make e hard for every area inside Nigeria to get light at once and for 24 hours daily. If e dey fixable, sharp! I go run am. 😌

Come here right now! @goldenproject @abdul-qudus but my momma @nkemakonam89 take your time and come ehn. 🥰

Sort:  

Hope I'm not late to the show

I forgot today is Friday

You're not, welcome.
What do you have for me this Friday? 🫠

Sweet love as usual

Who love wey nor dey give money help? 🫣

Tooor!!!
Our love is now transactional 🌛🌜

Make the first transaction please. 🌜🌛

I dey eat ..make this food no choke me😌😌

Yes..I am taking my time 😍

As it should be, you na Madam normally.
Eat for two please. 🫣

Lolz..just dey whyne me oo😂

Lol 🤣

We no go call them PHCN till then get sense first, so for now na NEPA them be.

This kind you no fit stress yourself, coping mechanism go always dey 😀

Na them cause am, NEPA na fit them. 😂

I can't come and kill myself at all. 😂

Abi ooo, life no too hard 😂

At all. 😂

E good to follow who know road just like you go befriend who get solar. Happy Friday 😃 😉

Yes o, life nor suppose hard normally. 😂

At all o. Make everywhere soft for all of us.

Amen o. 🤲

You better come my house come fix my own light asap

As wetin? NEPA wife? 😂

Na your new title be that oo

Abeg oo merit , if u wan make friend with babes wey get solar ..holla me make we go together go friend am🤣🤣🤣

Momma you go find your own solar friend for that beach side wey you dey na. 😂

I no get

I am friendless 🤣🤣

Wen hive no gree me make friends

I only know merit and princess 🤣🤣

Thank goodness say I fit Dey charge directly from our street transformer for night… na wetin be Dey save me since be that..

🤣🤣🤣
You don come! Crazy child.
Direct charge from transformer is on a whole level. 😂

I shall continue to called them Nepa, PHCN dey stressful, I no get strength.