Sort:  

Woman wan dey carry you go owanbe as per wat o ?

Escort boss. I'm there for the food...period

Abi oo

Na the most important 🙂

Na taboo for woman to carry man go owanbe?

Ask am oo abeg

Abeg help me ask am ooo

@beckyroyal dey always get owanbe to attend, so she's the perfect person

Thank God no be only me dey see am. Na why I wan follow her.

Na follow follow you be.

Why you no allow me follow you even once 😁

Make I chop rice, no wahala 😄.

Na who know road you go follow na.

Lol,you be man na. You suppose no road pass me

Lol. Na women dey sabi road to owambe pass oo

Abi o

Yes oo. Follow who know road dem talk. She sabi plenty roads...

Lol,I don calm down for Owambe ooo.

School go soon resume so no more party for now 😁

You still have at least one or two more weeks before resumption na

I need to rest ooo. Owambe no easy oo especially for Lagos

I can imagine

😂😂yes ooo

You dey sha enjoy ,Omo e make sense o. Sha school go still allow you go na

After each Owambe,body go dey pain me.

Abeg e don do

😂 na so e suppose be na ? Abi?
The consolation there be say you go chop belle full

Lolsss, that's true but many Owambe now, Dem dey restrict eating too much 😁

If na that one , e dey too sha , so I get that part . Them dey look face share food 😂

I no owe you anything ooo. Abeg put me down ooo 😁😁

Even owambe itself, know say you dey owe me owambe 😅

🤣🤣🤣🤣

Chai, which court go solve this case now

😄😅
E get one court behind my house. Dem dey settle dis kind matters. But no worry yourself cos you go lose. So just do the needful.

For where, I get faith say I no fit lose.

Which colour of lip stick dey my lips when I promise you Owambe ? 😂😂😂

Forget your faith, I know your fate. Na my guys dey run the court. Winning is my portion...

Your favourite colour 🙂😄

Na me go win.

I no get favourite lipstick colour. You see say you don lose😝

You still get hope like that niyen

I get hope oo 🙂