You are viewing a single comment's thread from:

RE: WETIN I DO WHEN I SMALL WEY MAKE DEM DISOWN ME.

in #esteem β€’ 6 years ago

Lol @zizymena mama, so u stubborn like this too. Well, na blood e dey too, u know wetin I dey talk na ba πŸ˜€πŸ˜€..

Well, my own still long too but I go shorten am small. Me and my younger brother no dey like go school. In fact then we hate school. Our papa himself like school o so we dey dodge school mostimes. Our papa dey work for one bank for onitsha and we dey stay for Asaba. So as early as 7am, popsi don move dey go office. E go remain me and my younger brother for house. If we nor won go school, we go just lock ourselves inside house till when students don dey come back from school, then we go come out make e for b like say we go school too. Sometimes sef, we go dogde go Gamehouse, stay there play game o till school go close.

We nor know say one man for the compound dey observe us. E con catch us one day come go report give our dad, the beating wey we chop that night ehhhh, e still dey my head till now.πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚

Special shout out to @naijapidgin, ona get level sha.

Sort: Β 

πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ˜‚ I just dey imagine the kind beating wey una go chop that day.you no want go school you no let your brother go school too.

Na slap I first chop o... As e slap me ehhhh, I begin look for key wey fall from my hand